Better people, I greet all of una fundamentally. Me no been sabi say our country community dey for this hive o. On how I don sabi now, I don hold am stand. In fact, we die here.
Una know say person no fit dey inside water make soap enter him eye.
My name na David Thompson, I from south-south, for inside Akwa Ibom State, I be better style artist and bass kita man, but on how e be, I still dey learn from people where sabi ways pass me.
E get tori where me for like share here base on the tori telling challenge where dey go on for here.
E get one oga wher been marry better style fat aunty like that. We no know say this oga no dey enjoy him marriage o.
One Sunday, na so Oga com back from church, him com jack him wife carry comot outside.
The wife sef been dey surprise, na so she ask her husband, "my husband, e don tey u carry me like this o, abi u don start to dey romantic abi your love for me don start to dey grow again nii"?
Oga tell her say him pastor been preach for church say when every body reach home, make them carry their wahala show God, so na why him dey her dey show God..
E shock the woman well well.
We been settle the matta finish sha.
Make I drop mic for now, we go still dey relate.
#Nigeria
#naija