Yoruba people talk sey person we see fine thing no look, poverty go soon hol' am. Na so the thing do me one day when I dey waka for road— I see one babe wey go well like Beyonce. But as I sight her, I notice sey she fit dey older than me.
I dey reason sey this thing wey I wan do na ashawo work. Man wey when him see woman no fit rest na ashawo them dey call am. To add extra the woman wey I won reason dey older than me. But as I look this girl ehn, I say if thunder go fire me after now, make ih fire me.
As I reach her, I try hail her make she hear my voice, but I no wan to shout make she think sey I be thief.
I say “Hey.”
She look me like sey she wan know who I be.
Normally I for tell her— “you looked interesting so I thought I should talk to you.”
I come change my talk, “I’m Ebi.”
Where I wan reach with my gaming na where I go just say— “I'm Ebi, please love me.” But that day no go ever come. Also, I no wan make all those things mess up my game. All my bosses wey I learn from Mystery, Neil and Todd say live in the moment.
She say, “What, I looked familiar?”
I say “No you looked important, and I wanted to get to know you.”
I tell her sey she dey “important” because, I don dey reason how I go run older girl, Important go well.
She say “ok?”
She asked me why she never see me for this street before. I come dey tell about myself sey I be medical student sey I dey usually busy. As I talk am, come show her with my face sey I dey stressed.
As I dey talk I dey check her hand wether she dey married. I no wan make person find me kill.
She tell me sey she come from Efik, I come reason sey, nain make— nain make she dey like Beyonce.
She come dey teach me about her people.
The yanning go well die!
We come talk reach junction. I come ask her for her number.
She come do something wey make me feel like small boy.
She smile come look me come hail me like sey she be my guy them, “Ebi Ebi!”
I come laugh like mumu for road. If people for see us at that very time, them for think sey we be friends from before-before.
I come pull out my phone I come take her number.
That her Efik name I been struggle with am, but as for her surname, I remember sey one barber get am too.
As body dey sweet me, I go talk to the barber make him no vex sey I fit dey reason him elder sister.
But the guy talk sey him been see two of us dey waka, sey no be him sister but sey the girl go well like mad.
Him no believe sey I just dey meet her for road. Na so I come explain the story give am.