My country people, I don come today to come write my secondary school story give una make una follow me laugh small.
I get plenty of secondary school gist to yarn una but nah this very one nah dey sweet my belle well.
I start Secondary School at the age of 11 and because I know say I sabi find trouble and I dey stubborn, I no gree make my parent look for school for me, I waka find my own school and finally wey I come see my school, my school dey very far from home, you know why? Incase I do something bad wey teacher or principal go say bring your parent, e no go easy make my parent come school very fast or hear about wetin I do. I come thank God say, my parent na very busy people wey no dey house until night.
My school nah one prestigious school for Lagos, im name nah, KRISBETHEL COLLEGE and the Location na Ipaja, Ogun state. When I start that school unto say I be new fowl, I been dey do like say I no fit talk or kill fowl, even teachers they like me unto say I dey quiet, reserved, and intelligent. But when senior students come dey show me pepper, nah so I follow tear eyes give them for school.
When I come start to dey tear my eye, nah for my Junior Secondary School Three (3). School come bring in new Mathematics teacher wey from Ijebu. This teacher come dey do favoritism, and tribalism for class and unto say I from Akwa Ibom State and we get few of us from that state, nah so this thing come dey pain me. Na so I begin to put wahala for class anytime wey this teacher they class.
Abeg to all the Yoruba people for this community, make una no vex oo, but na true i wan talk . Ijebu people, no matter how dem go school, when you hear them talk, you fit piss for body 🤣. Na wetin happen for my class be that. This mathematics teacher dey kill people with laugh whenever him come class but once him finish, he no ask whether student understand or even hear wetin him dey talk, as far as people wey him love understand am, him no go explain for others make them follow they on the same page with am, na so him go begin dey give class-work.
You know say, when e reach subject like mathematics, no be everybody they understand the subject well, and when him finish he get people self wey dey de lost for road. We go beg this man tire, him go talk say him no dey go back or explain anything for anybody. Make we wey know understand am go meet people wey understand am, make them teach us like say no be the same school fees we dey pay.
Whenever he do this thing, I go keep quiet unto say him nah my teacher. if e come reach time for submission, almost half of the class dey fail am, you go come hear am dey curse us say we be blockhead and he go flog us.
One day, this man do do do, him cup come full, May 26 precisely. Him come class come teach Algebraic Expression, as him dey teach dey go, I dey for my seat dey boil like hot water. Na so I hear this man talk "gero instead of zero". Na so I turn look my partners in crime dem dey lost as I dey lost o, me wey no dey fit close my mouth see something pass, na so I ask them when they change zero to gero, them say them no understand wetin the man dey teach again.
Na so we begin dey boil with laughter ooo, na so him begin to ask question for class, I raise up my hand oo, the man think say I wan answer question. Question wey I no even understand, how I wan come give the answer.
I hear as the teacher say, yes Evelyn, I tell am say No, I no one answer question say I wan even ask question. Na so him begin to open eyes for me, say make I sit down. Unto say I stubborn, I no gree sit down oo. Finally, him come accept say make I ask the question.
Na so I tell am say i been wan correct am, say that thing no be "gero but zero". The man shock, my partners' wey been dey wait for the time, na so them begin to they laugh, so tah them no fit control there laugh again.
The man talk say him go flog me, say instead make I dey listen to teaching, I dey listen to him pronunciation, say I be Olodo. I gladly accept oo but I still tell am say make him correct himself, say no be "gero but zero". I come tell am say, how I wan listen to wetin him they teach wey I know say I know go understand instead I prefer to dey listen to his pronunciation. Class begin to laugh oo.
This man flog the living daylight out of me, that day but from that day henceforth, my mathematics teacher become my Padi. When the man come to teach, he go take him time teach make everybody for class understand. If he finish, he go call my name, "Evelyn, I hope you understand"? I go either answer Yes or No. If I say No, he go talk say make I come show am where I no understand make him explain again.
Na so from that day, I come become the spokeswoman for my class on behalf of people wey no from Yoruba.
This na my entry for this week challenge wey be our secondary School story for pidgin.