Hello friends and family am glad to find myself in the midst of lovely and wonderful intelligent people.
Seeing this topic am full of excitement to write about this topic cos it's a great chance to express myself. But permit me I go dey write pidgin English too on to say we be student.
Am use to managing exam stress with the three things I love pass na food o, football, and basketball. If you be student like me, you will understand say exam period pap.
For me ehn, exam dey feel like war everytime. Once I hear say paper dey come, my mood go just switch like wall switcher. Mind go be restless, my brain go begin calculate how many topics I never touch. But na food, football and basketball dey balance me na dem be my survival kit.
Food is my comforter. Anytime I dey serious to read especially at night, I dey load myself with correct snacks like chin-chin, gala, puff-puff, or chilled malt. Something dey sweet about reading when your mouth dey busy. Even my guys dey call me “Exam Chef” because dem sabi say my reading table dey always full like buka.
there comes football. When the tension don too much, I go take small break go play ball or watch match. Sometimes i kick ball around for street or school field, other times na to argue Messi vs Ronaldo with my crew. It help me refresh my brain small before I continue reading. Even if I fail exam, make my club no lose match o (another sabi saying)
Basketball? passion turn to therapy. That bouncing sound dey heal stress. No a pro, but that court na like freedom zone for me. Sometimes after night prep, I go dribble small or just shoot ball with one or two friends. Na vibing stuff.
But I no go lie, friends na blessing and wahala during exam. Some go ginger you to read, remind you say you have exam to write. Others go press phone, gist, or carry you go watch match when you suppose dey read. I don learn to balance I dey vibe, but I dey serious too.
So that’s me. I survive exam with enjoyment and struggle all join together. I no fit kill myself, I dey take am step by step. Passion + little pressure = my own formula.
Wetin be your own exam survival secret?
Thanks to @soma18 for tagging me on this.
Am tagging @oyinye-chi @julie100 @harmony01