MY PEOPLE, MY PEOPLE!
I dey greet Una oooo
Happy Sunday and hope say Una dey prepare to go church or Una dey church already for my catholic Steemians!
No be only me waka come ooo, I waka with @imbigdee on behalf of all the naijapidgin crew, come make this special announcement.
Today na our first ever variety show day and yamayama full ground remain.
This show dey happen by 5:30pm after everybody Don return from church for our discord channel...

This show no be one of those promise and fail projects wey dey happen.
Our mama @ogoowinner get hand with @zizymena for this one.
Alot of giveaways follow no be for mouth.
This show get part 1 and 2 ooo! It have hapun!
Part 1 na talent show
whether na singing oooo
whether na rapping
whether na comedy
whether na to laugh people wey dey contest
whether na to vote people wey dey contest
whether na to criticize people handwork
whether na bad belle talent you get
whether na village people you be
ABEG CARRY ALL COME, WE WANT THEM.
Then part 2 na Quiz ooo
This one na for everybody wey feel say their power reach...
No fear! The questions no hard, no be WAEC!
The questions na simply based on
Some Nigerian whales and aspiring whales
Their on going projects and reputations
Gist about the recent programmes wey dey go on for naijapidgin
Questions about our beautiful Nigerian Steemians wey dey support all of us.
THIS QUIZ SBD ALREADY DEY GROUND OOO FROM @imbigdee
Abeg this show na we own, we naija people and pidgin lovers.
We need all the Nigerian Steemians support.
We also waka like that dey find more sponsors ooo so that our talented naija people go fit make am small for life. 😜😜😂😂😂
If you be naija pelzin, you be whale or aspiring whale and you never support us and as you see this post you hiss... say you no go support us... Oya carry your hand go up... raise am higher... fold am and knock your head. 😂😂😂🏃🏃🏃 Make I run before transmission transmit me go transformer.
All talented and untalented participants Oya comment, upvote and resteem this post to qualify for this contest. And make sure you join our naijapidgin discord channel from here ooo to participate ooo
FIRST THREE PERSONS TO UPVOTE, COMMENT SWEET COMMENT AND RESTEEM NA 0.1 SBD FOR GRAB EACH!
once again special thanks to our Mamas @ogoowinner and @zizymena. And my Papa 😜😜😜 @imbigdee for the giveaways wey dey wait for participants for this gbedu wey dey burst brain show. 😘😘😘😍😍😍 I love Una reach moon come back! 😱
I remain Una special gallant WarriCalabar babe Itoro Archibong.😘😘😍😍