My country I trowey ogbonge salute for unah o.
How unah dey?
How unah take dey hold body for this we change?
My people as we promise unah to dey bring unah latest latest gist come unah domot….. especially the one wey concern us and the one wey the happen for we country so we the @naijapidgin community don reason this tori carry land unah domot make we chook mouth put base on how the matter dey hot.
This matter concern me and you because any decision way we make now we go either suffer am or enjoy am for the next years wey the come.
Nah so I wake up one morning say make I carry my phone do my normal thing wey I dey do make I first check my sbd wey I make, check my whatsapp messages, then do Facebook small nah so I just dey receive news and pop up message everywhere even for TV say our number one person for we country wey dey handle every matter, the person wey them dey call GCFR. don come outside declare say him want run for second tenure and wetin this one mean be say if him win for the next 4 years nah him go still dey in charge of matter for we country Hmmm…..
Nah true say for every country, the country people dey always choose people wey go run their matta base on the party system wey dem agree to the use and for we country naija our own party system wey we dey run nah democracy wey nah we go choose who go run our matter and the person go stay for 4 years first tenure after when em go run again and if him win him go come run our matta for another 4 years..
And our number one person wey dey run our matta for the country don come outside tells us say him don ready and him want comot for the second time.
After him don the finish him first tenure we been don the wait and expert weather him go comot again or him no go comot and finally him come talk am.
I remember the first time wey BABA want comot under APC him promise us plenty things we him go do the slogan wey dem carry come that time nah CHANGE, all of us been happy base on say we don see person wey go change our country.
Nah so we come vote am give am power him come the do things slow slow sotey them begin call am BABA go slow.
Now him don talk say em want run again and this time the slogan nah NEXT LEVEL….
The funny tori now be say since baba talk say him want run again nah so so people just the react anyhow, for social media, for tv even for street self.
Nah so I hear say immediately him declare nah so our stock market crash we come loss 50 milion abi nah billion self, e no finish o one of my guy talk em own say nah as buhari declare nah him we come get national rain which means say nah heaven the cry because baba want come again….
Some people say this buhari time nah so so suffer people the suffer now him want come back again……hmmmmm
MY COUNTRY PEOPLE NAH WATIN WE GO DO FOR THIS MATTER?
UNAH THINK SAY THIS NEXT LEVEL WEY EM DEY PROMISE US SO NAH THE WAY FORWARD?
UNAH THINK SAY EM GO FIT WIN AGAIN?
WETIN UNAH THINK SAY WE YOUTH FIT DO TO HELP THIS MATTER