I greet every naijapidgin personal person... Hope say una dey manage dis kind economy .
First of all make I greet una happy new month because this month na better tin go full am.
Fellow steemians, how hustle? We thank God say market don dey green small small, e go beta very soon. @naijapidgin dey wish unah a stress free day ahead.
As today go be, we jex wan yarn one shikini mata, make d resolution mata jex dey move dey go. Hope say una neva forget dis year resolution abi?
I know say some pipu resolution go be make dem impregnate Otedola's daughter, lol.
As u all know say today wey be tuesday na d first day of d month of may, first day wey dey d second quarter of d year, so how d mata go be.
Shey una don fufil unah first quarter i. e first 3month resolution, wetin be dat thing wey u promise urself,
Na dis thing @naijapidgin carry come our domot today oo
I believe say una don acheive unah first quarter resolution. Dats good.
So fellow steemians, hope say una don d set unah 2nd quarter resolution. As for me, i don set my second quarter resolution, wey be say i don dey pray on top.
So wetin @naijapidgin want make una do be say make unah list unah 2nd part resolutions so dat wen june month don start, u go get d fullest cost to appraise ur self for dis post..
As una know wetin dey sup for we whatsapp group, so ur comments fit earn u something
If u neva join [click here](https://chat.whatsapp.com/C0Tbv4dXGxI7H4qwMl10Qs
na @mittymartz carry dis post come
Reviewed by @zizymena @nmalove @oliverwilliams @horlaide