Naija pidgin good morning oo
How the weather dey for your side?
I hear say rain don dey fall, but the thing no gree reach Kaduna..
We don carry another ogbonge tori wey concern our youths and our future come again.
Federal Government don release thousands of youth from National Youth Service Corps (NYSC) again yesterday
NYSC good o.. E dey help people mix with other tribe, come know there culture.
E dey give youths wetin dem dey call work experience, and if the youths do the wey dey give them for their * Place of Assignment*, dem fit retain them and then unemployment don end for the person. But wetin dey pain me be say our youths dey always miss this opportunity, because dem no dey take their service year serious, most of them be ghost workers, most of dem no dey go work because e fit be say their PPA no dey pay, but dem forget say they fit meet their helper there, or the organisation fit retain them. Most of them dey run from the state wey government carry dem go, but dey no know if na that place their own gold mine dey, No be everybody go make am for city..
Una know say unemployement na one of the biggest issue wey we get for this countri
As the youths dey jolly yesterday, I come dey wonder wetin dem go do next?
How many Companies go give all these people work?
How dey go take survive without that little allawee wey dey enter?
Naija pidgin how una see this NYSC scheme, una feel say our government try give us this scheme?
If you feel say dem no try, wetin make you think so?
Make una begin chook mouth for this matter
Congratulations to myself @nmalove, I follow for the people wey finish NYSC yesterday..
Na @nmalove carry this matter come
na @mittymartz design this ogbonge avatar