πππππππππππππ
My naija pipu,correct pipu, correct pals, hw una side.
Hw una weekend dey take be, hope say unah enjoy d free day wey dey the week sha..
@naijapidgin talk say make i salute nd grit all of unah "good morning " say im dey wish u a stress free week days ahead
How hustle, hope say na pray n work u dey carri do all dis level l. We pray say all go sama well soonest.
D mata wey come our domot today na one kain serious mata wey we no observe. It don tey wey dis thing don dey disturb ma mind,if we check enviroment today, we dey see say na small pikin dey carry pregnancy most for dis atmosphere. I come term dis as 'Teen Natality'.
Wetin be TEEN NATALITY?
Teen Natality wey we also know as teen child birth, wey be say person wey neva pass age nineteen (19) go dey get pregnancy. Hmmn, country pipu, everywhere don spoil, population and poverty don dey work hands in hands.
Effect wey Teen Natality don cause:
Dem go misss several opportunities base on child bearing Dem fit no get opportunity to attend school peer pressure Too much pipu for population In some cases, dem fit lose their lifes.
As d mata don be, dis early child birth as far as naija dey concern no go at all.
Case study to be my environment: all dis child birth of a thing don lead to intense poverty, depression for d victim mind and for some cases stigmatization from relatives.
My naija pipu, hw una take reason dis mata.
Wetin we see for dis teen child birth of a thing.