Nna eh, wetin Steemit never do for my side? Chai! Steemit na baba! E don give me money, e don make me to dey write steady, dey open my eye well-well make I dey see wetin dey happen for world, dey happen for my side, dey happen for internet. I don carry Steemit dey fit helep my people now and then for dis our Naija wey no easy. Steemit na teacher and preacher, come be berekete employer put on top.
NOPICTURES
Why I come dey write pidjin for here? Na because say @ogoowinner wey be one heavy boss lady nwanyi oma for Steemit, she come carry another hot one enter 18-yard box ohhh; she no dey play for dis Steemit of a tin. Na so I come begin dey see as people dey type for pidgin left and right for dis our Steemit. Na im me sef come say "Ah, so because say I dey talk big grammar upandan for dis Steemit, na im e come be say una tink say I no dey local? Oya, I go show una!"
Na im I come siddon begin dey type this tin oooo; I come see say Naija true-true full Steemit. Everybody wey I sabi come dey do am, whether na my colleagues for @africaunchained, whether na Blockchain Bloggers, whether na @genesisproject (abi na @genesis-project), all join. As for those wey never dey do am (like @misterakpan, @gbenga, @ehiboss, @dante31, @thatdamiguy, @fisteganos and the rest of our Discord [and former Sankofa] crew; wetin hol una? 😁🤓)
Di tin make sense ooo, see as my hand wey don dry for one week for Steemit just dey flow like milk and honey as per say na dis ogbonge pidjin wey I come dey type.
Na wa oooo, my heart don bellefull with happiness say Naija dey grow wella for dis Steemit of a tin. Una well don ooooo!
