How una de my pipu, this topic wey my sister @ogoowinner talk ehn no be small mata o
This one na true life tori wey do me, e no easy friendly enemy de everywhere, na dem make my girlfriend break 6 years relationship in a day on top phone, as dem take de talk say make God de protect us from pipu wey de look us wey we no sabi and fake pipu i no believe am untill dem do me wayo
I love my girlfriend so te na anything she what i de give her, i know say that one no reach o, God help us our two waka go university, we no de same university we de talk everyday for phone and some kind weekend i go play go her side abi make she kan my side.
For one afternoon i pick her call, she say she just wn hear my voice i say no wahala as she wn cut the call she kan say she go like tell me something but she no get card i say no wahala make i call you back na. as i call back she say her friends de greet me o i say make she greet dem for me, i kan ask her say wetin you wn yarn me, na so she first catch breath say the talk heavy gan say she no sabi how she go take talk am sef, talk am anyhow i go understand baby, she laugh,
She say shey i sabi wetin her friends de yarn about me? i say no, her voice kan begin de shake for phone, she say her friends talk say i no de carry dem flex say there own boyfriend de flex dem pass me and she be fine girl say make she step up o, i laugh say make she no mind dem say na play dem de play jare
She say she still get wetin she wn still talk o, ehn as the mata take be now say she don see another bobo for her school say na him she wn follow go now, i no first get my sef, i ask say shey na wetin your friends tell you you sef wn de do now? say shey dn forget say na 6 years relationship e be, i never talk finish she change am for me o, ehn say shey me i wn marry her ni say abeg abeg she don tire say she wn try another guy.
To cut the whole tori short my pipu na so her friends wey i sabi make my girlfriend leave me till date o, e dn de reach 2 years now but e still be like say na yesterday she commot, i no sure i go fit love another person as i take love her again.
Na so friendly enemy scatter my relationship!
Thanks for stopping by... One love